BBC Pidgin of Wednesday, 19 March 2025

Source: BBC

President Tinubu swear in Vice Admiral Ibok-Ete Ibas as Rivers Sole Administrator

Bola Tinubu don swear in Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (Rtd) as Sole Administrator of Rivers State Bola Tinubu don swear in Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (Rtd) as Sole Administrator of Rivers State

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don swear in di Sole Administrator of Rivers State, Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (Rtd), at di State House, Abuja, di kontri capital.

Tinubu swear in Ibas on Wednesday following a brief meeting dem get togeda afta im appointment.

Dose wey witness di brief ceremony include di president Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, di Attorney General of di Federation, Lateef Fagbemi (SAN), and di Principal Secretary to di president, Hakeem Muri-Okunola.

Dis dey come less dan 24 hours afta President Tinubu declare state of emergency for Rivers sake of di crisis wey dey happun for di state.

E make di declaration for im nationwide broadcast on Tuesday 18 March.

Di president say im dey disturbed about di issues wey dey happun for Rivers State as di wahala neva end and efforts to calm di situation no dey yield any fruit.

President Tinubu bin invoke Section 305 (5) of di 1999 Constitution to make di declaration.

Di president suspend Govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof. Ngozi Odu for six month.

Oga presido also suspend members of di state House of Assembly for di same duration.


Timeline: Oda times Nigerian presidents declare a state of emergency

Di last time wey dis kain tin happen for Nigeria na 12 years ago, wen President Goodluck Jonathan declare state of emergency for three states in di north east region - Adamawa, Borno and Yobe States - sake of Boko Haram insurgency.

Dis na di oda times wey state of emergency don dey declared for Nigeria:

Plateau State - 2004:

Olusegun Obasanjo, wen e be President of Nigeria for 18 May, 2004, bin declare a state of emergency for Plateau State afta one ogbonge religious katakata bin happen for di state.

Obasanjo suspend di govnor dat time - Joshua Dariye - and appoint Chris Alli, a retired army general - as di sole administrator.

Di situation bin last from 18 May until 18 November, 2024, wen Dariye return to office.

Ekiti State - 2006:

Obasanjo also declare a state of emergency for Ekiti State on 19 October, 2006.

Dis na wen di state get political wahala wey almost cause breakdown of law and order afta di state lawmakers bin impeach Ayodele Fayose wey be di govnor dat time.

Obasanjo bin appoint a retired brigadier general of di Nigeria Army Adetunji Olurin to be di sole administrator of di state.

Olurin dey dat position reach April 2007 bifore e hand over to Tope Ademiluyi as acting govnor.

Adamawa, Borno and Yobe States - 2013

As boko haram insurgency start to dey get worse for di north east region of Nigeria for 2013, Goodluck Jonathan wey be Nigeria president dat time declare a state of emergency and impose curfew on Adamawa, Borno and Yobe states wia di insurgents bin dey disturb pass.

During im national broadcast on 14 May, 2013, Jonathan tok say di actions of di boko haram fighters "amount to a declaration of war, and we go hunt dem down, we go fish dem out, and we go bring dem to justice."

But Jonathan no suspend di govnors and state assemblies of di three states.

Di president say im dey disturbed about di issues wey dey happun for Rivers State as di wahala neva end and efforts to calm di situation no dey yield any fruit.

President Tinubu bin invoke Section 305 (5) of di 1999 Constitution to make di declaration.

Di president suspend Govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof. Ngozi Odu for six month.

Oga presido also suspend members of di state House of Assembly for di same duration.


Who be Ibok-Ete Ekwe Ibas?

Ibok-Ete Ekwe Ibas na retired Nigerian Navy Vice Admiral, wey be di 22nd Chief of Naval Staff (CNS) of di Nigerian Navy from 2015 to 2021.

Dem born am on 27 September 1960.

Na for Nko, Cross River State, south-south Nigeria dem born am and e join di Nigerian Defence Academy as a member of 26 Regular Course on 20 June 1979 and commissioned sub-lieutenant on 1 January 1983.

E attend Nko Primary School, Nko, for 1966 and complete am for Big Qua Primary School, Calabar for 1971. E kon proceed to Hope Waddell Training Institute Calabar from 1972 to 1976.

Between 1977 and 1979, e attend School of Basic Studies Ogoja bifor e go di Nigerian Defence Academy for 1979.