You are here: HomeAfricaBBC2024 07 12Article 1940176

BBC Pidgin of Friday, 12 July 2024

Source: BBC

Rescue operation dey go on as school wey collapse for Jos trap several students

Di building collapse wen school bin dey in session Di building collapse wen school bin dey in session

Rescue operations dey go afta one two-storey building wey dey house one school collapse on Friday morning for Plateau State, northcentral Nigeria.

Di building collapse wen school bin dey in session and students bin dey receive lectures.

E neva clear how many pipo don die but di fear be say several students don die and injure, according to di National Emergency Management Agency (NEMA).

Security agencies and rescue operators dey use excavators to rescue students and teachers wey dey under di rubbles.