BBC Pidgin of Tuesday, 22 October 2024

Source: BBC

Russians fit don die inside plane dem shoot down for Sudan

RSF share videos from di allege crash site on Monday, come say e find documents wey show say Russian RSF share videos from di allege crash site on Monday, come say e find documents wey show say Russian

Russia embassy for Sudan say e dey investigate report say, for Dafur dem shoot down one cargo plane wit Russian crew.

Dafur na one key battle ground for di Sudan civil war between di army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF).

Di plane wey dem identify as Russian-made lyushin Il-76, bin dey mission to deliver equipment and medicine to di city of el-Fasher wey dey under army control, military sources tell Sudan local tori pipo.

On Monday, RSF say dem shoot down one Russian-made plane wey Egyptian military bin dey fly, wey dem accuse say dem bin dey bomb civilians - though dem bin identify am as Antonov.

Egypt deny accusations say e dey provide military support to Sudan army during di 18-month conflict.


Di brutal struggle for power between Sudan army and RSF bin start for April 2023, dis one lead to wetin UN don call one of di world worst humanitarian crises.

Some estimates dey suggest say up to 150,000 pipo don die since di war begin last year, according to comments wey US special envoy for Sudan Tom Perriello, make for May.

UN dey reason say dis fight fight don also pursue more dan 10 million pipo - about 20% of di population – comot from dia house.

Details about di plane crash and wetin bin be dia mission never clear.

Russia embassy for di capital, Khartoum, say e go colabo wit Sudan military goment to gada more informate about di crash and di pipo wey bin dey inside.

According to Sudan Tribune news website, all members of di crew - including three Sudan kontri men and two Russians – bin die for di crash.

E quotes military sources wey say e come down for di Malha area, near border wit Chad, as e dey go di city of el-Fasher. BBC never fit independently confam.

El-Fasher na di only city wey still dey under army control for western Darfur region - and e don dey under attack from RSF since April.

RSF say e get di plane black box and im seize documents wey relate to di plane and im mission.

Viral video from di alleged scene of di crash show RSF soldiers wit wetin look like Russian passports and identification cards next to wetin remain of di plane.

Some reports suggest say na technical fault fit don cause di crash - but both di army and RSF dey say na shoot dem shoot am down.

Odas dey suggest say e fit be say na by mistake dem target am.

Dis na becos, some documents wey BBC see for one video wey dey circulate suggest say di aircraft dey affiliated wit one airline wey bin get link wit United Arab Emirates (UAE) before.

UAE deny di allegations say e bin dey give RSF weapons - though UN say e get credible evidence.

Fresh diplomatic attempts to negotiate make di hostilities between di rival military for Sudan stop don fail to make progress.

Violent fighting don recently enta anoda level recently around di Sudan capital Khartoum, wey majorly dey under di RSF, as di military dey increase airstrikes for di city centre and southern belt.