BBC Pidgin of Friday, 10 January 2025

Source: BBC

Supreme Court go sentence Trump on hush-money case

Trump react to Supreme Court wey no gree stop di sentencing in di hush-money case Trump react to Supreme Court wey no gree stop di sentencing in di hush-money case

Justice Juan Merchan don sentence president-elect Donald Trump to unconditional discharge of all 34 charges for covering up hush-money wey im bin pay one porn star.

Merchan tell di court say e rule like dat becos unconditional discharge na "di only lawful sentence, witout encroaching upon di highest office of di land".

Dis na as e tell Trump say, "I wish you Godspeed as you assume your second term for office".

Unconditional discharge mean say Trump no go face any fines, probation or jail time.

But Trump don enta im Truth Social to post say im go appeal.

E write say, "Di Radical Democrats don lose anoda pathetic unAmerican Witch Hunt."

Im add say di "result alone prove wetin all legal scholars and sabi pipo don tok, no case dey, case bin no dey and dis whole scam bin fully deserve to dey dismissed. Today event na despicable charade, and now wey e don finish we go appeal dis hoax".


Earlier, di Supreme Court bin reject Oga Trump last-minute attempt to stop di sentencing wey go make am di first felon wey go stay for White House.

Trump bin ask di court to consider weda im dey entitled to automatic stay of im sentencing, but di justices reject im application by 5-4.

Court find Trump guilty of fake records to cover how im take pay $130,000 hush-money to porn star Stormy Daniels as im claim say na legal expenses for 2016.

Trump bin watch from a video link

Donald Trump, wey bin attend all di days of im hearing for dis case physically, attend di proceedings for im sentencing virtually. Di president-elect and im lawyer Todd Blanche pop up on a video feed at di defence table.

Di two men sit side by side, and prominent American flags form di backdrop of di shot.

Trump face strong as e sit wit im lawyer. Di hearing start wit some procedural matters.

Prosecutor Joshua Steinglass tok bifor di judge give im sentence.

E start by saying di pipo recommend sentence of unconditional discharge" wey be wetin di judge don indicate say im go do.

Steinglass for im statement bifor di court accuse Trump say im bin wan downgrade di trial as im call am witch hunt.

E say di call don make members of di court and even prosecutor staff to dey get threats.

But becos of Trump inauguration wey dey ten days away, "di American public get di right to presidency wey no dey tied down by pending court case".

Meanwhile, Trump lawyer Todd Blanche wey join wit Trump virtually say dis case suppose no enta court in di first place.

Donald Trump sef follow chook mouth inside say "dis na terrible experience" and say di case bin come up so e no go win re-election even though im win both popular vote and electoral college. E also tok say e dey innocent for di charges wey dem charge am wit.

Since im re-election, Trump lawyers don try to convince many judges say make dem apply presidential immunity protections to di president-elect for di Manhattan criminal case.

Manhattan goment lawyers argue for Supreme Court say Trump "extraordinary immunity claim no get any support from any decision from any court".

Separately, one group of former public officials and legal scholars file one letter of support to di Supreme Court, asking di justices make dem reject Trump "attempt to avoid accountability".

Also, one federal appeals court for Georgia on Thursday reject request to block one portion of special counsel Jack Smith report into Trump alleged plot to prevent transfer of power to Joe Biden after 2020 election.

Why Trump sentencing take long like dis?

Donald Trump bin dey convicted say im falsify business records last May but dem bin postpone im sentencing plenti times.

At first, Trump bin supposed to dey sentenced for July but Justice Merchan decide say im go postpone afta ruling from Supreme Court wey declare say presidents get immunity from prosecution for official acts.

Merchan tok say e bin need more time to review di ruling.

Anoda date bin dey set for September but Merchan decide say di ruling go happun afta di presidential election wey Trump win.

Finally Merchan bin decide say na 10 January im go give di sentencing.