You are here: HomeAfricaBBC2024 09 11Article 1950235

BBC Pidgin of Wednesday, 11 September 2024

Source: BBC

Takeaways from Trump-Harris debate as both candidates clash on key issues

US Vice President Kamala Harris and former president Donald Trump US Vice President Kamala Harris and former president Donald Trump

US Vice President Kamala Harris and former president Donald Trump bin clash for dia first presidential debate on Tuesday night for Philadelphia.

Di ogbonge presidential debate dey come less dan two months bifor di polls.

Trump and Harris debate bin cover many issues as both candidates tackle demsefs.

Harris bin present herself as a pragmatic problem-solver and diminish Trump as a wannabe dictator wey no fit keep im rally crowds engaged.

Trump bin attack Harris as a radical and frequently return to im theme of criticizing migration, and sometimes im bin veer into conspiracy theories.

Na US broadcaster ABC host di 90-minute debate at di Philadelphia Constitution Center at 21:00 local time.

Harris tok on di size of Trump rally crowds, im conduct during di Capitol riot and on di officials wey serve for im administration wey don become outspoken critics of im campaign - and dis point put Trump on di back foot.

If dem dey win and debates on which candidate best take advantage of issues wia dem dey strong - and defend or deflects on areas of weakness - Tuesday night dey in favour of di vice-president.

Dem cover topics like economy and abortion. Public opinion surveys indicate many Americans no happy wit how di Biden administration, wey Harris na key member, bin handle inflation and di economy.

But Harris turn di topic to Trump proposed across-di-board tariffs, wey she label a “Trump sales tax”, and den bring up Project 2025, di controversial independent conservative plan for a future Republican administration.

As e bin do for past, Trump distance imsef from di project and defend im tariff plan, and add say Biden administration bin keep many of di tariffs for im presidency. Dem be valid points, but e keep am from hammering di vice-president on inflation and consumer prices.

On abortion, Trump defend im handling of di issue, and tok say Americans from a wide range of background bin want Roe v Wade abortion protections to dey overturned by di Supreme Court – a statement wey polling no support. E bin struggle to make im position clear and im answer at times na just to ramble.

Harris, meanwhile, take di opportunity to make an impassioned, personal appeal to families wey don face severe pregnancy complications and don dey unable to receive abortion care for states that wey don ban di procedure – states wit “Trump abortion bans”, as she call dem.

“Na insult to di women of America,” she conclude.

Na carefully modulated message for area wia she get double-digit advantage over Trump.

Takeaways from Trump-Harris debate

.Kamala Harris and Donald Trump accuse each oda of weakness and lying in for dia first debate of di 2024 US presidential election

In cllosings, Harris tok say she dey focused on di future as Trump counter by calling di US ''a failing nation'

.Harris running mate Tim Walz said afta di debate say Harris show her ''vision'' while JD Vance, wey be Trump running mate, call dem ''platitudes'''

.On Israel, Trump tok say war no go dey if na im be president and Harris call for a ''two-state solution'' and end to war

.Almost immediately afta di debate, pop star Taylor Swift endorse Harris on Instagram, and call her a ''gifted leader''

.On abortion rights, Trump tok say im bring di issue back to states while Harris cite Project 2025, and tok say bans deny women care.

.Harris tell Trump say Putin "na dictator wey go eat you for lunch" while Trump call her "di worst vice-president in history"