Anybody wey get African passport go fit visit Ghana witout visa, na wetin President Nana Akufo-Addo tok.
E announce di plan for im final state-of-the-nation address last Friday. Im tok say di policy go start dis January, 2025.
Visa-free travel within di African continent na wetin many pipo wey dey promote pan-African values bin dey fight for and dem dey also see say e dey veri important for economic cooperation.
Ghana na di fifth African kontri to give travellers from di rest of di continent free entry without visa.
Oda kontris na The Gambia, Rwanda, Seychelles, Benin.
Economy and tourism:
President Akufo-Addo tok say di visa free entry to Ghana from oda African nationals go help trade for di kontri.
"I dey proud to approve di visa-free travel to Ghana for all African passport holders, with effect from di beginning of dis year," Akufo-Addo told lawmakers for im last address to parliament bifor im step down next week afta eight years in office.
"Dis na di logical next step to di African Continental Free Trade Area and di workings of di largest trading bloc for di world," im tok as im dey refer to di zone wey come on board four years ago.
Increase Ghana ranking:
Dis visa free entry to Ghana by oda African kontris don also improve dia ranking.
For di annual African ranking of visa-openness, Ghana bin dey fifth last year as dem bin already offer visa-free travel to citizens of 26 continental kontries.
Ghana in recent years bin don dey promote di kontri destination for pipo from di continent and di African diaspora to visit.
To encourage oda Africans to invest:
Di announcement according to President Akufo-Addo go also bring pipo wey get African roots to come invest for di kontri.
For 2019, Akufo-Addo bin launch di Year of Return - an initiative to encourage di pipo wit African roots to invest for di kontri.
Di president bin use im last state-of-the-nation speech to review im two terms in power.
Despite say im bin oversee tough economic times for most Ghanaians, im tok say "growth donm return to di pre-Covid trajectory" im add say im dey leave behind a kontri "wey dey do well".
Akufo-Addo no run for re-election last month sake of say im two term don finish, but di man from im party wey dm chose to succeed am, Vice-President Mahamudu Bawumia, lose di election by a large margin to John Mahama.
Dem go swear in President - Elect, John Mahama on Tuesday.