BBC Pidgin of Thursday, 9 January 2025

Source: BBC

Trump, Biden and Obama honour former President Jimmy Carter at state funeral

Di body of Jimmy Carter don arrive in Washington DC Di body of Jimmy Carter don arrive in Washington DC

Di body of Jimmy Carter don arrive in Washington DC, wia di former US president go lie in state bifor a large state funeral.

Carter bin die on 29 December at di age of 100 for im hometown of Plains, Georgia.

Dem bin first hold one funeral service for am for Atlanta on Saturday at di Carter Presidential Center, wia hundreds of members of di public come pay dia last respects.

Di largest funeral celebration for Carter dey take place for di Washington National Cathedral.

President Carter's grandson speaks first, focusing on his life of service



Di first speak at President Carter funeral na im grandson, Joshua Carter.

Joshua remember how im grandfather bin dey committed to teach Sunday School for im home for Plains, Georgia throughout im life.

"E bin teach di Bible evri Sunday from World War II to Covid," e tok, and add: "Evri time I go church wit am, pipo dey full."

E say di church dey get many pipo from around di world, wit different backgrounds and beliefs.

Joshua say im grandfather dey begin im Sunday School teachings by talking about im week - and illustrate di remarkable life e bin live.

"If e monitor election, e go tok about am. If e stop a conflict, e go tok about am. If e eliminate disease from a village or a kontri, e go tok about am," Joshua tok.

"Wen my brother Jeremy die, e announce dat news for Sunday School."


Wetin be state funeral?

State funeral for di US na very ceremonial event wey dey mostly reserved for former president.

Dis burials dey sometimes held for high ranking officials or military leaders but e depend on di sitting president.

Di events for am det include Lying in State period wia dem go fly di bodi go Washington DC often for military aircraft. Dem go come keep am for di Capitol Rotunda for few days so mourners from di public go it come pay dia respects.

Afta words na di state funeral service for di National Cathedral wia plenti dignitaries dey mostly among those wey go attend.

Afta dat, di bodi go go wia dem decide to bury am. For President Carter, na for im hometown of Plains, Georgia wia dem go bury am next to im wife, Rosalynn for im family peanut farm.