BBC Pidgin of Wednesday, 9 April 2025

Source: BBC

Trump 'explosive' global tariffs dey take effect wit 104% rate on China

US President Donald Trump US President Donald Trump

US President Donald Trump tariffs announcement wey im do few days ago dey take effect, including di 104 per cent wey e sama China.

Dis new import taxes, wey Trump impose via executive order, dey expected to send economic shockwaves around di world and e argue say e go allow di United States to economically flourish.

Trump tariffs na for 60 kontris wey e tink say dem be di "worst offenders" wey include di 104% duties wey go affect China.

Di additional tariffs on China bin kick off afta Beijing refuse to meet Trump deadline say make dem withdraw dia own do-me-I-do-you levies wey dem sama on di US.

Meanwhile, China exports to di US amount to 2% of dia total economic activity and di message from Beijing na say dem fit ride am out, di BBC China correspondent tok.

Trump say di tariffs dey "explosive" and go boost di US economy, but sabi pipo warn say dem fit push up prices for consumers.

Wetin Donald Trump tok

Wen Trump dey tok during di Republican Party dinner, e say di tariffs go dey "legendary, for positive way".

"Many kontris...don rip us off left and right, but now na our turn to do di ripping," e tok.

Trump don also describe di tariffs as "somehow explosive" and "amazing", wit claim say import tariffs dey alreadi generate "almost $2bn (£1.5bn) a day" for di US.

Dis tariffs na huge hit for anyone for China wey wan sell into di US market.

Na just a waiting game for di Chinese govment to reveal dia own counter measures.

Trump tok tok pesin say belief dey say China gatz negotiate well but China no wan do anytin.

Wetin be China reaction to di tariffs

China dey accuse Trump say e dey employ 'bullying practices' to do di issue of im tariffs.

China tok for one White Paper say di US no fit solve problems of trade deficit and "lack of industrial competitiveness" through di tariff measures wey e dey introduce.

"Dem seriously damage global trade order and di security and stability of global industrial and supply chains," according to di document.

China maintain say di China-US trade relations dey "mutually beneficial", even though kontris fit get counter, dem gatz respond to each oda interests.

Now wey Trump sama China wit 104% import duties, different reaction don begin dey enta.

China foreign affairs tok tok pesin speak during a news conference say di Chinese pipo "legitimate right to development no supposed dey deprived" by charges on dia goods.

Lin Jian dey accuse di US of "bullying practices", and urges Trump administration to show attitude of equality and mutual respect to resolve di gbege through dialogue.

E say dat if Trump "insists" to provoke a trade war, "China go dey compelled to fight to di end".

Wetin next for China

E dey clear say most Chinese imports to di US go now face a 104% tariff, as di trade war between dis two world biggest economies no dey show any sign say e go slow down.

"We don reach di phase wey go likely lead to long-term economic pain," Alfredo Montufar-Helu, a senior adviser to di China Center for Conference Board tink tank, tell di BBC bifor di latest tariff take effect.

E neva clear how di US go find alternative supply for Chinese goods on such short notice, but di trade war line dey drawn alreadi.

"I tink di US dey overplay dia hand," Deborah Elms, Head of Trade Policy at di Hinrich Foundation in Singapore tok.

E neva clear how di go end, but China say dem dey readi to fight to di end if di tariffs stand.

How we take reach dia

.20 January: Trump use im inauguration speech to outline plans to over ride di trade system "to protect American workers" and introduce tariffs on foreign kontris "to enrich our citizens"

.1 February: E announce a 25% levy on Canadian and Mexican imports to di US - and an additional 10% on China

.3 February: Mexico and Canada reach a deal to pause US tariffs for one month

.10 February: Trump announce a 25% import tax on all steel and aluminium wey dey enta di US

.4 March: Di White House place an additional tariff on Chinese imports

.12 March: Trump 25% steel and aluminium tariffs take effect

.26 March: Di White House reveal new 25% duties on car and car parts wey dey come into di US - e take effect from 2 April


.2 April: Trump announce dat di US go impose "reciprocal tariffs" on certain kontris, as well as a universal 10% levy on imports from all oda kontris

.5 April: Di 10% "baseline" tariff come into effect

.9 April: Custom tariffs on roughly 60 kontris- on di worst offenders - come into effect