Donald Trump tok say im "no dey joke" wen e say im wan do third term as US president.
Di US Constitution say "no body... go dey elected more dan twice", but some Trump supporters don suggest say ways fit dey around am.
Wen dem ask am for one interview wit NBC about di possibility of seeking a third term for di White House, Trump say "methods dey on how to run am".
"I no dey joke... plenty pipo want make I do am," e add. "But, I just dey tell dem say, we still get long way to go, you know, e still dey very early for di administration."
Dem ask Trump, wey go be 82 at di end of im second term, e go wan continue dey serve for "di toughest job for di kontri".
"Well, I like to dey work," e ansa.
These no be di first time e go express im willingness to serve for third term.
Di first comments on di topic na for January, wia e tell im supporters say supporters say e go be "di greatest honour of my life to serve not once, but twice or three times or four times". However, e later say na joke for di "fake news media".
Wetin di US Constitution tok?
Di US Constitution bin rule out anyone from having a third term. The 22nd Amendment states:
"No body go dey elected to di office of di president more dan twice, and no body wey don hold di office of president, or act as president, for more dan two years inside one term bifor dem elect anoda president go dey elected to di office of di president more dan once."
To change di constitution go require a two-thirds approval from both di Senate and di House of Representatives, plus approval from three-quarters of di kontri state-level governments.
Na Trump Republican Party dey control both chambers of Congress but dem no get di majorities wey dey needed. Additionally, di Democratic Party dey control 18 out of di 50 state legislatures.
How Trump go fit president for a third term?
Trump supporters say one loophole dey di constitution, untested in court.
Dem argue say di 22nd Amendment only clearly ban pesin from being "elected" to more dan two presidential terms - and say nothing of "succession".
Under dis theory, Trump fit be di vice-presidential running-mate to anoda candidate - perhaps im own vice-president, JD Vance – for di 2028 election.
If dem win, dem go swear di candidate into di White House and then e go immediately resign – and let Trump take ova by succession.
Steve Bannon, one podcaster and prominent former Trump adviser, tok say im believe say Trump go "run and win again", e add say "a couple of alternatives" dey in determining how.
Andy Ogles, one Tennessee Republican for di House of Representatives, bin introduce one resolution for January wey call for constitutional amendment to allow a president serve up to three terms - as long as di service no be back to back.
Dis go mean say only Trump out of all former surviving presidents go dey eligible - Barack Obama, Bill Clinton and George W Bush all of dem bin serve consecutive terms, whereas Trump win for 2016, lost for 2020, and e win again for 2024.
However, di high bar for constitutional amendments don make Ogles' proposal unrealistic - although e get plenty reactions from pipo.
Who kick against Trump third term?
Democrats get deep objections.
"Dis na yet anoda escalation for im clear effort to take ova di government and scata our democracy,"Daniel Goldman, one New York Representative wey serve as lead counsel for Trump first impeachment tok.
"If Congressional Republicans believe for di Constitution, dem go openly oppose Trump ambitions for a third term."
Some pipo within Trump party also think say na bad idea.
Di Republican Senator Markwayne Mullin, of Oklahoma, bin tok for February say im no go support any attempt to put Trump back for di White House.
"I no go change di constitution, first of all, unless di American pipo decide to do am," Mullin tell NBC.
Wetin legal experts tok?
Derek Muller, one election law professor for di University of Notre Dame, say di Constitution 12th Amendment tok say "no body wey dey constitutionally ineligible to di office of president go dey eligible to dat of vice-president of di United States".
E mean say serving two terms in office disqualify anyone from running as a vice-presidential candidate, for im own view.
"I no think say any 'weird trick' dey to getting around presidential term limits," e tok.
Jeremy Paul, one constitutional law professor for Boston Northeastern University, tell CBS New "no credible legal arguments" dey for a third term.
Anybody don serve more dan two terms?
Franklin Delano Roosevelt dey elected four times. E die three months into im fourth term, for April 1945.
Di Great Depression plus di Second World War bin call Roosevelt time in office - and pipo dey often cite am for im extended presidency.
For dat time, dem neva write di two-term limit on US presidents into law - instead na one custom dem bin dey follow since George Washington refuse a third term for 1796.