US President and Donald Trump administration don exclude smartphones, computers and some oda electronic devices from "reciprocal" tariffs, including di 125% levies wey im impose on Chinese imports.
For one notice, US Customs and Border Patrol say dem go exclude di goods from Trump's 10% global tariff for most kontris and di much larger Chinese import tax.
Dis mark di first significant reprieve of any kind for Trump tariffs on China, one trade analyst describe dis as a "game-changer scenario".
Late on Saturday, while im dey travel to Miami, Trump say im go give more details of di exemptions from di start of next week.
"We go dey very specific," im tell tori pipo for Air Force One. "But we dey collect a lot of money. As a kontri we dey collect a lot of money."
Di move dey come afta concerns from US tech companies say di price of gadgets fit skyrocket, on to say many of dem dey made in China.
Dis exemptions - dem backdate am to 5 April - also dem include oda electronic devices and components, including semiconductors, solar cells and memory cards.
"Na dream scenario for tech investors," Dan Ives, wey be di global head of technology research for Wedbush Securities, im post am on X. "Smartphones, chips dey excluded na game-changer scenario wen e come to China tariffs."
Big tech firms such as Apple, Nvidia, Microsoft and di broader tech industry fit breathe a huge sigh of relief dis weekend, im add put.
Di White House say dis exemptions na to ensure say companies get more time to move production to US.
"President Trump don make am clear say America no fit rely on China to manufacture critical technologies like semiconductors, chips, smartphones, and laptops," White House Press Secretary Karoline Leavitt tok for statement.
"Wit di direction of di president, dis companies dey hustle to onshore dia manufacturing for United States as soon as possible."
Trump, wey dey spend di weekend for im Florida home, tell reporters on Friday say im dey comfortable wit di high tariffs on China.
"And I feel say something positive go come out of dat," im tok, as im tok about im relationship wit Chinese President Xi Jinping.
Dis electronic goods still subject to di 20% tariff on China e dey related to fentanyl, na wetin White House Deputy Chief of Staff on Policy Stephen Miller post on X.
Some estimates suggest say iPhone prices for US for triple if di costs dey passed on to consumers.
US na major market for iPhones, while Apple account for more dan half of its smartphones sales last year, according to Counterpoint Research.
Dem say as much as 80% of Apple iPhones wey dem plan to sell for US na China dem dey make am, di remaining 20% dem dey make am for India.
In recent years like dia fellow smartphone giant Samsung, Apple dem dey try to diversify dia supply chains to avoid over-reliance on China.
India and Vietnam emerge as frontrunners for additional manufacturing hubs.
As di tariffs take effect, tori be say Apple dey look to speed up and increase dia production of India-produced devices in recent days.
Trump bin plan for a host of steep tariffs on kontris around di world to take effect dis week.
But on Wednesday im announce say im go pause for 90-days for kontis wey dey hit by higher US tariffs - except China, wey im raise dia tariffs to 145%.
Trump say im tariff increase for China na because say di kontri bin ready to do dia own 84% levy on US goods.
For ogbonge change of policy, Trump say all di kontris wey no retaliate against US tariffs go receive di reprieve – and dem go only face a blanket tariff of 10% – until July.
White House also di move na negotiating tactic to extract more favourable trade terms from oda kontis.
Trump say im import taxes go address unfairness for global trading system, as well as bring jobs and factories back to US.