Search and rescue team dey look for Ghanaian player, Christian Atsu who dem possibly dey trapped under rubble after earthquake hit Turkey.
De Ghanaian player according to reports for Turkey be unaccounted for, but dem dey try find de Astu de another staff member, Taner Savut.
De earthquake hit parts of Turkey around 4.00am on Monday.
Before dis incident Christian Atsu score goal inside game wey en team, Hatayspor win.
He even tweet about de outcome of de game on twitter before de incident.
Important win for the team
— Christian Atsu (@ChristianAtsu20) February 5, 2023
Happy to be on the scoresheet ???? @hatayspor pic.twitter.com/eMhlS0JGWr