You are here: HomeAfricaBBC2024 07 07Article 1939308

BBC Pidgin of Sunday, 7 July 2024

Source: BBC

Wat next for Mali, Chad, Burkina Faso afta dia breakaway from Ecowas

A meeting of leaders of di West African regional bloc, ECOWAS dey happun for Abuja. A meeting of leaders of di West African regional bloc, ECOWAS dey happun for Abuja.

A meeting of leaders of di West African regional bloc, ECOWAS dey happun for Abuja.

Di summit come as obvious political and security challenges dey worry di region.

For one rival meeting on Saturday for Niamey, di military rulers of Niger, Mali, and Burkina Faso form a breakaway confederation of Sahel states, sometin wey catch many pipo by surprise for mata wey don end any expectation of say dem bin wan rejoin ECOWAS.

Members of ECOWAS now do reduce to 12 kontries – sometin wey fit reduce di power more.

Di Sahelian neighbours remain stubborn despite efforts to convince dem wit plans of setting up ECOWAS regional force to fight jihadist insurgency.

But efforts to intervene in doz kontirs return to do bloc dey expected to generate tok-tok during di meeting today.

Nigeria president Bola Tinubu dey expected to dey reappointed as chairman of di authority afta im tenure expire dis month. E go also be Di first meeting for Senegal and Liberian presidents.

President Bola Tinubu go remain as di chairman of di authority of Economic Community of West African States heads of state and goment.

Dis na afta dem extend di Nigerian leader tenure for di 65th ordinary session of di authority of heads of state and goment meeting wey happun on Sunday for Abuja.

Na for 9 July 2023 dem first elect President Tinubu for Guinea- Bissau.

For im acceptance speech im say im focus na to build on di values of democracy and uphold di interest of di regional body wey go clock 50 years next year.

"I appoint Senegal President Bassirou Faye and I ask am make im be my special envoy to Burkina Faso, Mali and Niger Republic, him and Togo President Faure Gnassingbe go work hard wit our brothers for Mali, Burkina Faso and Niger Republic, dem go work wit me and di Ecowas commission wia necessary". President Tinubu tok.

"I accept to kotinu to serve our interests and to build on our democratic values and di structure wey we inherit." Tinubu add.

Earlier President Tinubu tell heads of states and goment of Ecowas to work towards di establishment to sustain a regional standby force for security and economic development of di community.

Di summit come as obvious political and security challenges dey worry di region.

For one rival meeting on Saturday for Niamey, di military rulers of Niger, Mali, and Burkina Faso form a breakaway confederation of Sahel states, sometin wey catch many pipo by surprise for mata wey don end any expectation of say dem bin wan rejoin Ecowas.

Members of Ecowas now don reduce to 12 kontries – sometin wey fit reduce di power more.

Di Sahelian neighbours remain stubborn despite efforts to convince dem wit plans of setting up Ecowas regional force to fight jihadist insurgency.

But efforts to intervene in doz kontirs return to do bloc dey expected to generate tok-tok during di meeting.

Di Nigerian leader appoint Senegal President Bassirou Faye and Togo President Faure Gnassingbe as special envoy to go Burkina Faso, Mali and Niger Republic.