You are here: HomeAfricaBBC2024 06 18Article 1936266

BBC Pidgin of Tuesday, 18 June 2024

Source: BBC

Wetin bin dey di Finance Bill wey cause kasala for Kenya

President William Ruto President William Ruto

Kenya goment don make U-turn to address di issues afta plenti kasala bin burst ova over one Finance Bill 2024 wey President William Ruto goment bin dey propose to take fund di 2024/2025 budget for di kontri.

Kenya dey ruled by di Kwnaza goment and na President Ruto be di chairman.

Di Kenya Kwanza Parliamentary Group bin announce on Tuesday say dem don drop some of di issues wey dey di bill.

Dem say dem listen to di pipo of Kenya afta dem protest against di Finance Bill sake of how e go affect dem.

Inside di bill, some taxes and levies wey go affect bread, transportation and even sanitary towels bin dey dia.

Di Majority Leader of di National Assembly for Kenya Kimani Ichung’wah say dem agree to drop some of di VAT during public participation.

According to President Ruto, im say di engagement ontop di Finance Bill and dia decisions na part of wetin democracy be.

"We don adjust di document accordingly and we dey glad say we dey get dis conversations about issues, and our institutions dey work. Dis na how democracies suppose function."

Wetin Kenya goment comot for di Finance Bill

VAT on bread, vehicle and sugar

Kuria Kimani wey be di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di taxes and levies wey dey imposed for di finance bill no go dey again.

Kimani tok say di 16% VAT wey dey ontop bread go comot. E say e go lift di burden on di pipo.

Im also announce say di Kenya goment don comot di 2.5% wey dem bin dey propose to impose ontop vehicle.

Kimani also announce di removal of excise duty ontop vegetable oil. For di same statement, di chairmo say VAT ontop transportation of sugar go also dey removed.

Increase in mobile money transfers and VAT on financial services

Di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di increase for mobile transfers no go dey again. Im tok am wen im bin dey read di statement on Tuesday.

“Increase for mobile transfer no dey,” Kimani tok.

Di VAT ontop financial services and oda foreign exchange transactions go also comot, according to Kimani.

Levies on Housing fund and locally manufactured products

Kimani say products wey be locally manufactured no go attract Eco Levy. Im add say e go help boost di manufacturing capacity for Kenya.

“Locally manufactured products wey include sanitary towels, diapers, phones, computers, tyres, and motorcycles, no go attract di Eco Levy,” Kimani tok.

Di chairmo add say di levies ontop Housing Fund and Social Health Insurance go become income tax and “e go put more money for di pockets of employees."

Kimani say some levies ontop locally manufactured alcohol go be according to di volume so e go make di manufacturers fit dey produce safe alcohol.

“Dis therefore mean say many small businesses go no longer need to register for VAT. Excise duty ontop alcoholic beverages go come dey taxed sake of di alcohol content and not di volume."

"Di higher di alcohol content, di more excise duty e go attract. Alcohol manufacturers dey expected to make safer and cheaper alcohol."

Kuria Kimani add say "Locally assembly and manufacturing go help boost Kenya manufacturing capacity, create jobs, and save foreign exchange”.