You are here: HomeAfricaBBC2024 07 15Article 1940784

BBC Pidgin of Monday, 15 July 2024

Source: BBC

Wetin to know about JD Vance wey Trump pick as im running mate

Donald Trump don announce say e don choose Ohio Senator JD Vance (L) as im vice-presidential nominee Donald Trump don announce say e don choose Ohio Senator JD Vance (L) as im vice-presidential nominee

Donald Trump don announce say e don chose Ohio Senator JD Vance as im vice-presidential nominee.

"After lengthy deliberation and thought, and considering di ogbonges talents of many odas, I don decide say di person best suited to assume di position of Vice President of di United States na Senator JD Vance of di Great State of Ohio," Trump write.

Meanwhile, Republicans don also officially nominate Trump for presidential election.

E bin receive di majority of delegate nominations for Republican National Convention.

Trump son Eric, wey dey represent Florida, put Trump over di threshold.

JD Vance profile
Born James David Bowman for Middletown, Ohio for 1984, Vance come from a white, working class family mostly of Scottish-Irish decent. Na im maternal grandparents raise am for di former-booming Appalachian coal kontri wey now be one of di kontri poorest areas.

Vance join di Marines for four years and serve for Iraq before going to Ohio State University, wia e receive degrees in political science and philosophy.

From dia, e attend Yale Law School, and den write a successful memoir, Hillbilly Elegy, wey some reviewers describe as offering a window into di conservative white working class wey dey often dey overlooked.

For 2017, Vance move back to Ohio from California, wia e bin dey work for biotech, and set up im own venture capital operation with support from PayPal founder Peter Thiel, wey one time be libertarian and ogbonge Republican for Silicon Valley.

For early 2021, Thiel gvie $10m (£8m) to one committee wey dey seek to recruit Vance as a Senate candidate.

Once Vance join di race, e sharparly change im tone regarding Trump, apologising for calling am "reprehensible" before and even repeating di president false claims of voter fraud for di 2020 election.

With endorsement from Trump, e gbab di Senate seat and don since become ogbonge influential voice for Washington.

At only 39, Vance go provide a youthful counterpoint to di elderly candidates for di top of both presidential tickets. Trump choice don position di Ohioan to be atdi forefront of a new generation of Maga Republicans. And if di former president return to di Oval Office next year, Vance go instantly join di conversation for di party 2028 presidential nomination.

Wetin to know about Donald Trump decision
Di pick suggest say Trump know say dis election go dey won and lost for industrial Midwest battleground states.

Oga Vance na from Ohio, e become popular afta di release of im bestselling memoir Hillbilly Elegy, wey tok about im blue- collar upbringing and how e affect im politics and worldview.

Wit im background, Vance fit dey well positioned to connect wit and energise di kind of white, working class voters wey narrowly deliver those states to Trump for 2016.

Di former president write for im social media post to announce im decision, e write say im running mate “go dey strongly focused on di pipo im fight so brilliantly for, di American workers and farmers for Pennsylvania, Michigan, Wisconsin, Ohio, Minnesota and far beyond".

Trump praise im running mate military service and im "Ivy League law school pedigree".

At only 39, Vance go provide a youthful counterpoint to di candidates for di top of both presidential tickets. Trump choice don position di Ohioan to be at di forefront of a new generation of Mega Republicans. And if di former president return to di Oval Office next year, Vance go sharply join di conversation for di party 2028 presidential nomination.

But Vance, bin criticise Trump in di run-up to di election for 2016 - something wey Democrats bin quick point out - but since den im don become an outspoken defender of di former president, particularly on television news networks.

Im recent loyalty, and effectiveness, no doubt play a big for Trump decision.

Wen dem ask am weda im believe Trump 2020 election defeat bin dey fairly decided, Im say no. Im also say, unlike Oga Pence, Im go try to block di certification of di election results for Congress on 6 January 2021, di day of di Capitol riot.

Oga Vance also align closely wit di former president political ideology. Dem get similar views on trade, immigration and foreign policy. Oga Vance dey particularly critical of di continued US support for Ukraine.

For areas wia di two men no bin agree, Oga Vance don move toward im new running mate. im, for example, bin back away from im earlier stand against allowing women wey be victims of rape or incest from getting access to abortions.

Trump ova di course of im campaign don tok about some of im plans as president for a second term – wit across-di-board tariffs, a pledge to deport tens of millions of undocumented migrants and an aggressive realignment of di federal bureaucratic workforce. Vance pick na anoda evidence say Trump don doubled-down on Trumpism.

Dat, too, na something im Democratic opponents dey sure to point out. On Monday, Oga Biden bin tell reporters say im no see any difference between Oga Vance and di former president.

“Im be clone of Trump on di issues,” im add put.