You are here: HomeAfricaBBC2024 07 19Article 1941335

BBC Pidgin of Friday, 19 July 2024

Source: BBC

Wetin we know about di mass IT outage wey dey affect businesses around di world

Some kontris around di world dey face ogbonge Information Technology [IT] outage. Some kontris around di world dey face ogbonge Information Technology [IT] outage.

Some big global institutions including major banks, media outlets and airlines for some kontris around di world dey face ogbonge Information Technology [IT] outage.

Di US state of Alaska don warn say dia emergency services dey affected, and according to tori di mass IT outage don affect London Stock Exchange too.

Australia na di kontri wey di IT outage hit pass sake of say dem don suspend flights.

Supermarkets dey also experience di kasala sake of say pipo wey buy tins no dey fit pay.

E dey aslo affect broadcast networks wey dey scramble [struggle] on air sake of say autocue, graphics and computers no dey work again.

Wetin dey cause dis IT wahala

Tori be say dem neva really know di cause of di outage as e still dey unclear, but many of di pipo wey dey affected don link am to Microsoft PC operating systems

One official Microsoft 365 service update wey dem post for X earlier in di day say "we dey investigate di issue wey dey impact users ability to access various Microsoft 365 apps and services".


How e don affect pipo worldwide

However one Microsoft tok-tok pesin tell di BBC on Friday say " dem don recover di majority of services earlier" in di day.

One tok-tok pesin for di Australia Home Affairs Minister say e be like say di outage dey related to one issue for global cybersecurity firm Crowdstrike, and di kontri cybersecurity watchdog say no information wey suggest say na attack.

“Our current information say di outage relate to one technical issue wit a third-party software platform wey affected companies employ," dem tok for statement.

Reuters bin cite sources wey say London Stock Exchange don also suffer outage, while Alaskan officials say many 911 and non-emergency call centres no dey work again properly.

Meanwhile for Sydney Airport, information disappear from departure boards. For one announcement to passengers for di domestic terminal, budget carrier Jetstar say “issue wit Microsoft” mean say dem dey unable to check in passengers, or to board dia flights.

Virgin Australia also tell dia travellers say dem get "complete ground stop" of flights.

Meanwhile Social media users don report say queues dey for Australian stores like Woolworths, as payment systems dey down, and telecom firm Telstra also report issues.

Di largest provider for di kontri, say call to dia company emergency service contact centres no dey affected, but say dem dey work wit state emergency services wey di IT outage affect to implement backup processes.

Kontris for di world and Africa bin face a similar challenge wen fibre optic cable bin spoil under high sea.

E affect internet services for some days before dem repair am.