BBC Pidgin of Thursday, 2 January 2025

Source: BBC

Wetin we sabi about suspect for New Orleans attack wey kill 15 pipo

Di names of some of di vicitms wey die for Jabbar hand don begin come out Di names of some of di vicitms wey die for Jabbar hand don begin come out

Di Federal Bureau of Investigation (GBI) don name di assailant for di New Orleans attack wey happun on New Year Day as 42-year-old Shamsud-Din Jabbar, wey be Army veteran and US citizen from Texas.

At 03:15 local time on New Year Day, one Ford pickup truck bin run into crowds wey gada for Bourbon Street for di heart of New Orleans French Quarter.

CCTV footage shows one white, Ford F-150 Lightning vehicle wey bin drive onto di pavement to get around a police car bifor e hit pipo wey bin dey pass.

Police describe di act as "veri intentional", and add say di attacker bin get determination to kill and damage.

"Dis man bin dey try to run over many pipo wey im fit run into", New Orleans Police Chief Anne Kirkpatrick tok.

Jabbar bin get gun and also shoot at law enforcement personnel and injure two officers. Na police gunfire kill am.

Who be di victims?

Among di pipo wey die for dis attack wey claim di life of at least 15 pipo, na one popular American college footballer, young girl wey wan become nurse, one mama of four pikin dem.

Families and relatives of di victims dey gradually release dia names before authorities complete autopsy.

Dis na wetin we sabi so far.

Martin 'Tiger' Bech

Martin "Tiger" Bech na former football player for Princeton University.

Di university confam im death.

"E no get any more appropriate nickname of Princeton player wey I coach," Princeton football coach Bob Surace tok for one statement.

"Im be 'Tiger' in every way - strong competitor wit endless energy, a beloved teammate and caring friend."

Martin Bech brother, Jack Bech, post tribute for X beside news article wey report im death.

"Love you always broda!" im write. "You bin inspire me everyday now you go need to dey wit me every time. I got dis family T, no worry. Dis na for us."

Bech be member of di 2016 and 2018 Ivy League Championship teams.

Nikyra Cheyenne Dedeaux

Di 18 years old bin dey hope to become nurse.

Na her mama, Melissa Dedeaux, confam her death for social media.

"I lost my baby just pray for me and my family pleaseeeeee!!! God I need you now!!," di mama beg, togeda wit her pikin foto wia she wear one red graduation cap and gown from dis year.

Madam Dedeaux - wey also be nurse - tell local tori pipo Nola say her pikin bin dey ready to start her nurse training later dis month.

She add say Nikyra bin sneak out of di house wit one of her cousin and her friend, di two survive.

Nikyra school friend, Dante Reed, tell New York Times say im bin receive call from her cousin, say dem run wen dem bin hear gunshots, and say she - Nikyra - dey miss.

Her grandmama, Jennifer Smith, tell di paper say "she be tin of joy for di small time we bin get her."

"I dey very proud of all of my grandchildren, and dat one especially."

Reggie Hunter

Di confirmation of di death of di store manager and papa of two na by im cousin Shirell Robinson Jackson wey give di news to CBS News, BBC News US partner.

Madam Jackson describe am as "full of life", and say di 37-year-old bin message di family some minutes after midnight to wish dem Happy New Year.

Im bin dey wit anoda cousin wey injure for di attack.

Oga Hunter younger sister, Courtney Hunter, tell NY Times say her broda love to dey around family and bin dey competitive wen e come to playing games.

Kareem Badawi

Her papa, Belal Badawi, confam Kareem death, as im express "great sadness and grief".

Oga Badawi say: "We ask Allah Almighty to shower im mercy on am, and give us patience and strength to overcome dis".

"We belong to Allah, and to im we shall return", im add di expression wey Muslims dey commonly recite wen dem hear say anoda Muslim die.

Last year, one Facebook post wey Oga Badawi do congratulate Kareem afta im graduate from high school.

Kareem be student for University of Alabama, wey im president, Stuart R Bell, say: "I grieve wit di family and friends of Kareem for dia heart breaking loss."

Bell message - wey dem share for di faculty Facebook page - also ask pipo to "take a moment to pray for pipo wey dis tragedy affect."

Hubert Gauthreaux

Hubert Gauthreaux former high school, Archbishop Shaw, na im confam di 21-year-old death for social media.

"We dey ask di whole Archbishop Shaw family to pray for di repose of Hubert soul, im family and friends during dis difficult time, and all di pipo wey dey affect by dis tragedy.

"Eternal rest grant unto him, O Lord, and let perpetual light shine upon him. May di souls of all di faithful departed, through di mercy of God, rest in peace."

Nicole Perez

Kimberly Usher Fall, Madam Perez friend and boss for deli store wey she dey manage, call her dedicated, smart and "good-hearted pesin", according to CBS.

"She bin dey beautiful and full of life," she write for one online fundraiser wey she bin set up for her friend.

Di 27-year-old bin also be mama of one four-year-old boy.

Madam Usher Fall say Madam Perez bin dey carry her pikin come work on di days wey im no go school.

She bin dey teach am mathematics and alphabets inside deli storage room in between work, Madam Usher Fall tell Di Washington Post newspaper.

"She bin really be good pikin, man, she really be," she tok, come add say "she bin just dey get everything going, and she don go, just go."

Matthew Tenedorio

Di 25-year-old audio-visual technician get "laid-back spirit and infectious laughter" wey bin dey bring joy to pipo around am, according one fundraiser wey im family bin set up in im name.

Im mama, Cathy Tenedorio, tell US tori pipo NBC News, say di last time she bin see her son alive na 21:00 local time on New Year Eve, come add say she remember say she hug and kiss am.

Di University of Georgia president say one of dia students bin dey critically injured, while di Israeli goment say two of dia kontri men dey among di pipo wey injure.

Police say e be like say di victims na mainly area pipo from New Orleans, even though many tourists bin visit New Orleans for di New Year celebrations and di now-postponed Sugar Bowl, part of di American football college play-offs.

Who be Shamsud-Din Jabbar?

Forty-two-year-old Shamsud-Din Jabbar na Army veteran and US citizen from Texas.

Dem find one flag wey dey associated wit di Islamic State (IS) group for di vehicle im bin dey drive, and di FBI say dem dey investigate which affiliations Jabbar fit get wit terrorist groups.

For one evening address, President Joe Biden say di FBI don brief am on di attack. Di suspect bin upload videos on social media "mere hours bifor di attack" and dis indicate say im bin dey inspired by IS and express "desire to kill", Biden tok.

Dem also find improvised explosive devices for di area.

Authorities also recover one long gun wit "suppressive device" wey bin act as silencer.

According to one LinkedIn profile wey don dey removed now, Jabbar bin work for various roles for di US Army, including for human resources and IT, bifor dem discharge am. Dem deploy am to Afghanistan from February 2009 to January 2010.

For one YouTube video wey im post for 2020, Jabbar say im time for di military don teach am "di meaning of great service and wetin e mean to dey responsive and take evritin seriously, dotting i's and crossing t's to make sure say tins go off witout a hitch".

Im bin study for Georgia State University from 2015 to 2017, and graduate wit degree in Computer Information Systems.

Im bin marry two times. Im first marriage bin end for 2012 and im second marriage bin last from 2017 to 2022.

E be like say im don work for real estate, and hold one licence wey bin expire for 2021. Im bin get criminal record wey relate to traffic offences and tiff tiff.

Di pick-up truck im bin dey drive na electric and belief dey say im bin rent am for Texas via one app wey dem dey call Turo.

Additional suspects dey?

Di FBI say dem believe say di suspect bin get help in carrying out im attack, particularly for placing suspected explosive devices.

CBS report say law enforcement neva release evidence of dose wey help am.

Earlier reports say authorities bin dey review video footage, but CBS report say di footage don dey determined to only show bystanders.

Wia dis tin happun?

Pipo sabi Bourbon Street well-well for nightlife and tourist hotspot, restaurants, bars and clubs plenti for dia wit live music.

E dey within New Orleans French Quarter, one lively area wey dey attract tourist and locals, especially to celebrate New Year.

Na di French bin establish am for 1718, and di original grid of streets wey dem bin design back den dey for di heart of wetin dey draw visitors to di city.

Evri year, millions of pipo dey go di famous Mardi Gras carnival and parade for di spring, wey dey famous for di strings of colourful beads wey party-goers dey wear.