BBC Pidgin of Friday, 29 November 2024

Source: BBC

Wetin you need sabi about gallbladder wey bin threaten actress Omotola Jalade life bifor she remove am

Nigerian actress, Omotola Jalade Ekeinde Nigerian actress, Omotola Jalade Ekeinde

Nigerian actress, Omotola Jalade Ekeinde, popularly known as Omosexy, don tank Baba God afta one life-threatening health emergency wey make am battle for her life.

For one post on her Instagram page, di ogbonge actress say she bin undergo surgery to remove her gallbladder afta serious back and chest pain and vomiting.

According to di actress, she begin experience dis wen she bin dey busy dey work on her feems and attending di Academy Voting Members’ screening of Gladiator II.

She say she vomit all through di night till notin dey to vomit again and dem rush am to emergency for di third time.

“Den di doctor come in and say you gatz go in immediately for surgery! To remove gallbladder. E bin dey large, di doctor wonder how I bin no dey for more pain. More pain???!” She write on Instagram.

“So di fight for my life begin and today I dey return to give all di glory to God. On dis day, weda you dey US or not, e get so much to thank God for, take some time to join in and give thanks.”


Wetin be gallbladder

Gallbladder na small, pear-shaped organ wey dey store and release bile. Bile na di fluid wey liver dey produce wey dey help digest fats for di foot wey pesin eat, according to Cleveland Clinic.

Bile dey help di digestive system break down fats. Bile na mixture of mainly cholesterol, bilirubin and bile salts.

Di gallbladder dey located for di upper right part of pesin abdomen (belly). E dey sit just under pesin liver.

How di gallbladder dey help oda organs

Di gallbladder dey connected to oda parts of di digestive system through a series of bile ducts called di biliary tract.

Di biliary tract, wey dem dey also call biliary system or biliary tree, na system wey be like pipe wey dey carry bile from pesin liver to di intestine.

Bifor pesin start to dey chop, im gallbladder don full of bile. Wen pesin start to dey chop, di gallbladder receive signals to contract and squeeze di stored bile through di biliary tract.

Di bile eventually find im way to pesin largest bile duct, di common bile duct. Bile dey pass through di common bile duct into di duodenum, di first part of di small intestine, wia e dey mix wit food waiting to dey digested.

After pesin eat, di gallbladder dey empty and resemble balloon wey dem don deflate, and dey wait to dey filled up again.

Wetin be di signs or symptoms of gallbladder problems?

Di symptoms of gallbladder problems dey vary. Some pipo no dey feel gallstones or even know say dem get dem.

But if gallstones block di flow of bile, dem fit affect di gallbladder or pancreas.

a. Pesin fit experience di following symptoms:

b. Upper right abdominal pain.

c. Upper mid abdominal pain.

d. Upper right abdominal pain wey extend to di right shoulder or back.

e. Pain afta eating a fatty meal.

f. g. Jaundice (pesin skin go yellow and dia eyes go white).

g. Nausea and vomiting.

h. Fever.

i. Chills.

j. Light-brown pee or light-coloured poop.

How dem dey treat gallbladder issues?

Dem fit treat most gallbladder issues wit di removal of di gallbladder. Surgery to remove di gallbladder na cholecystectomy.

Di gallbladder no be essential organ. Dis mean say you fit live a normal life witout gallbladder.

Wen a surgeon remove di gallbladder, bile go flow out of di bile ducts directly into di digestive system instead of to dey stored in di gallbladder first.

Surgeons fit perform cholecystectomies three ways:

Open cholecystectomy: Wit open surgery, di surgeon go operate through one large incision. Di surgeon fit perform open cholecystectomy if di gallbladder dey seriously inflamed or scarred.

Laparoscopic cholecystectomy: Wit laparoscopic surgery, di surgeon go operate through a few small incisions. Laparoscopic surgery dey generally lead to a faster recovery, less pain and smaller scars. In most cases, cholecystectomies go dey performed laparoscopically.

Robotic cholecystectomy: Dis na more recent method and e dey available in a small number of centres.