You are here: HomeAfricaBBC2024 07 10Article 1939760

BBC Pidgin of Wednesday, 10 July 2024

Source: BBC

Who be Bishop Allan Kiuna, popular religious leader wey e death shake Kenya

Bishop Allan na popular preacher for Kenya Bishop Allan na popular preacher for Kenya

Popular preacher wey also be di general overseer of Jubilee Christian Church (JCC) for Kenya, Bishop Allan Kiuna don die, according to statement from di church.

Bishop Allan na popular preacher for Kenya wey plenti pipo regard as pesin wey don touch lives of pipo for di kontri and di death really shake dem.

Di church describe Bishop Allan as preacher wey don make so many marks for di world and for di bodi of Christ.

“Na heartfelt condolences to announce say our beloved Bishop Allan Kiuna don go be wit di Lord.”

President William Ruto don send condolence message afta di death of popular preacher wey also be di general overseer of Jubilee Christian Church (JCC) for Kenya, Bishop Allan Kiuna.

Bishop Allan die on Tuesday 9 July 2024 according to one statement from di church wey confam am.

Bishop Allan na popular preacher for Kenya wey plenti pipo regard as pesin wey don touch lives of pipo for di kontri and di death really shake dem.

President Ruto say im dey mourn wit di Christian community and di family of di late Bishop.

“Na wit profound sorrow I learn of di passing of Bishop Allan Kiuna. I dey join di Christian community to mourn im death and Bishop Kiuna na dedicated Christian leader wey found di Jubilee Christian Church (JCC) and inspire many to follow di teachings of di Lord,” President Ruto write for im X page.

Di president say im mourn wit di wife ‘in dis time of grief.’

On dia part, di church describe Bishop Allan as preacher wey don make so many marks for di world and for di bodi of Christ.

“Na heartfelt condolences to announce say our beloved Bishop Allan Kiuna don go be wit di Lord.

Bishop Allan Kiuna, di general overseer and founder of Jubilee Christian Church na extraordinary man wey touch di lives of many and im get great passion for ministering not just locally but globally.” Di statement add.

According to Kenyan broadcasting corporation, Bishop Allan bin battle cancer since 2019 and im undergo multiple myeloma cancer treatment for di US wia dem declare am cancer-free.

Myeloma cancer na type of bone marrow cancer wey dey affect di blood cells and e dey multiple sake of say e dey always affect plenty places for di bodi.

Plenti Kenyans don take to social media to send dia condolences to di family.

Kanini Kega wey be di national secretary of Jubilee party say di late Bishop na im friend and di death dey very sad.

“Na very sad day indeed. My friend Bishop Allan Kiuna of JCC church, may you shine on your way. Sad!”

Di church describe late Bishop Allan as not ''not only spiritual leader but also loving husband, father, grandfather and friend.”

Dem say dem go announce di funeral arrangements soon.