You are here: HomeAfricaBBC2024 07 16Article 1940787

BBC Pidgin of Tuesday, 16 July 2024

Source: BBC

Who be Blord, why police arrest am?

Nigeria Police Force confam di arrest of Linus Williams, wey many pipo sabi as BLord Nigeria Police Force confam di arrest of Linus Williams, wey many pipo sabi as BLord

Nigeria Police Force don confam di arrest of Linus Williams, wey many pipo sabi as BLord.

Blord chop arrest for Abuja on Tuesday, July 16, di authorities tok.

Di authorities dey accuse Blord companies of cryptocurrency fraud, terrorism funding, aiding internet fraud and non-compliance wit regulatory frameworks.

‘’We go do our due diligence for our investigation. Our Cyber space for Nigeria must dey safe and secure by all means. We dey committed to achieving dat,’’ Olumuyiwa Adejobi police tok-tok pesin tok.

Blord neva react to police allegations dem but im arrest dey cause plenty tok- tok for social media.

Some pipo for social media don chook mouth inside di mata.

Popular influencer VeryDarkMan wey bin carry di businessman go police say ‘’E go hard for Blord to comot from dis case.’’

According to VDM e say Blord bin get case already for police bifor im bring im own come.

Nigeria na Africa biggest economy and also one of di world biggest cryptocurrency markets.

Cryptocurrencies no dey illegal for Nigeria but companies must register in order to operate dia, goment tok.

All dis dey happun few months afta Binance wahala wit Nigeria goment.

Nigeria goment bin demand $10 billion dollars as penalties from di biggest cryptocurrency exchange platform for di world

Dis na on top accuse say di cryptocurrency platform cause massive losses for di kontri becos dem dey fix exchange rate.

Di goment say Binance influence di increase in foreign exchange rates sake of how dem dey speculate di currency for di kontri wey don make di Naira fall by almost 70% in recent months.

Who be Blord?

Blord na Nigerian businessman wey dey do cryptocurrency trading and get millions of followers for social media.

Na him be di founder of Blord Group of Companies.

Blord Group of Companies get various ventures like cryptocurrency trading, gadget stores, luxury stores, automobile dealerships, and real estate investments.

Im business don extend beyond cryptocurrency, for April 2013 im launch BillPoint mobile app .

Di businessman wey dey very popular get ova 3.4 million followers for Instagram, dey use im platform to push im business dem online.