You are here: HomeAfricaBBC2024 07 16Article 1940895

BBC Pidgin of Tuesday, 16 July 2024

Source: BBC

Who be Ekene Adams, di Labour Party lawmaker wey die at di age of 39

Ekene Abubakar Adams die at di age of 39 on Tuesday morning. Ekene Abubakar Adams die at di age of 39 on Tuesday morning.

Di lawmaker wey dey represent Chikun/Kajuru Federal Constituency of Kaduna state for di House of Representatives don die.

Ekene Abubakar Adams die at di age of 39 on Tuesday morning.

Tok-tok pesin for di Nigeria House of Representatives, Akin Rotimi confam im death for inside statement.

According to reports, di lawmaker die afta long sickness.

Oga Adams wey be Labour Party (LP) lawmaker, na first time member of di House, and until im death, serve as di Chairman, House Committee on Sports.

Di Green Chamber describe am as “dedicated public servant, pesin wey dey passionate about sports administrator and kind philanthropist wey many pipo love.”

Plenty pipo don dey send tributes to mourn di passing of Oga Adams.

President Bola Tinubu don tok sorry to di National Assembly and di Kaduna state govnor on di passing of di lawmaker. E also tok sorry to im family and friends.

Kaduna state Govnor, Uba Sani say, “Ekene leave us at a time wen we need im services di most. But we dey comforted say e leave legacy of selfless service, humility and compassion.”

Labour Party, di party wey e belong to say dem dey shocked wit di tori of im passing.

Di national chairman of di party, Julius Abure say im dey sad wit tori of im death as e be one lawmaker wey dey tell pipo for power di truth, even wit im small age.

“Though e just spend one year in office but im impact for Chikun/Kajuru Federal Constituency and di entire Kaduna state dey big. Just few months ago, e donate transformers, cars and Motorcycles give communities and individuals within im constituency.” Oga Abure tok for di statement.

Di Nigeria Football Federation also express grief and sorrow on di death of Ekene.

Dem say e be pesin wey put mind on di development of football for Nigeria.

Dem born am for 1985, Adams na Nigerian entrepreneur, politician and former professional footballer.

Before im tenure for di House, Oga Adams don hold some positions for di sports sector. E bin serve as di general manager of Kada City Football Club and Remo Stars Football Club for Ikenne.

Di LP lawmaker na di third member of di House of Reps wey don die dis year.

Im death come about one week afta di death of Olaide Akinremi, di lawmaker wey represent Ibadan north federal constituency for di House of Representatives.

Di lawmaker die at di age of 51 afta brief sickness.

For May 2024, di lawmaker wey bin dey represent Babura/Garki Federal Constituency of Jigawa State, Isa Dogonyaro die at di age of 46.