BBC Pidgin of Tuesday, 22 October 2024

Source: BBC

Who be Shirley Ayorkor Botchwey wey fit be di new Commonwealth Secretary General?

Ghana's minister for Foreign Affairs and Regional Integration, Shirley Ayokor Ghana's minister for Foreign Affairs and Regional Integration, Shirley Ayokor

Ghana Ministry for Foreign Affairs and Regional Integration, Shirley Ayokor Botchwey dey in di running to bicom di second eva African Secretary-General for di Commonwealth.

Di voting and appointment of di next Commonwealth Secretary-General go happun for di Heads of Goment meeting for Samoa wey don start from 21 October to 27 October.

Di way dis regional rotation for dis position dey go mean say dis time e dey come from Africa.

Di new Commonwealth Secretary General go replace Patricia Scotland from Dominica wey di Caribbean don dey di office since 2016.

Di last African wey dey dat position na Emeka Anyaoku from Nigeria from 1990 - 2000.

Africa make up for ova one third of all di 56 kontris wey dey part of di Commonwealth of nations.

So who be Shirley Ayokor Botchwey wey dey run from Ghana?

Di Commonwealth Parliamentary Association describe her as lawyer, diplomat and politician wey don dey work as di Foreign Minister for Ghana since 2017.

Bifor dat she work as Deputy Foreign Minster, Deputy Minister for Trade and Industry and den member of di Ghana Parliament wey she hold for four terms.

She claim to don lead di move for di unanimous passage of one resolution wey go make sure say UN fund Africa-led peace support operations for November 2023 wen Ghana bin dey inside di UN Security council.

She also claim say she collabo wit oda Ministers for Ghana to run 'Year of Return' and 'Beyond di Return' policies.

But two oda candidates dey from Africa for di position.

Dem be Senator Joshua Setipa from Lesotho and Dr Mamadou Tangara from Gambia.

Senator Joshua Setipa

Joshua Setipa recently bin dey appointed as di Senior Director of Strategy, Portfolio, Partnerships and Digital Division for di Commonwealth Secretariat.

Di Southern African Development Community (SADC) bin stamp im candidacy gidiba.

Oga Setipa spend im early years as protocol officer for di Lesotho Foreign Service.

Wen e bin dey work as Lesotho diplomat for di World Trade Organization for 1998, e follow for di pipo wey draft di initioal proposal wey helep to create di group of kontris wey dey dey call di SVEs.

E bin also work as di Minister of Trade and Industry and most recently as di Managing Director of di UN Technology Back for Least Developed kontris.

Dr Mamadou Tangara na Gambian diplomat wey be di current Minister of Foreign Affairs, role wey e don get bifor for 2010, and again for 2012.

E also be di former Gambian Permanent Representative to di United Nations.

E bin also hold office as di Minister for Higher Education, Research, Science and Technology and e bin serve as Minister for Fisheries, Water Resources and National Assembly Matters.

E hold di position for Coordinator of di National Authorizing Office Support Unit for European Union-funded programmes and projects for di Gambia and also bin work as di forcal point ofr anytin wey concern di United Nations Educational, Scientific and Cultural Organization (UNESCO) Science Sector.

E claim say e be di only candidate for dis position wey dey recognised as one of di longest-serving African Foreign Minsiters wey no just get high-level diplomatic experience but also get political and developmental accolades.

Wetin be di work of di Secretary-General of di Commonwealth

Di Secretary-General of di Commonwealth na oga of one of di three inter-governmental organizations wey be di Commonwealth Secretariat, di Commonwealth Foundation and di Commonwealth of Learning.

Di Commonwealth Secretary-General dey represent di Commonwealth for outside.

Di pesin also dey work as di Chief Executive Officer of di Commonwealth Secretariat.

Di Secretary-General dey nominated by Commonwealth leaders and fit serve maximum of two terms wey get four years per term.

Di work of di Secretary-General na to promote and protect di Commonwealth values, represent di Commonwealth for public and manage di Commonwealth Secretariat.