You are here: HomeAfricaBBC2024 08 30Article 1948310

BBC Pidgin of Friday, 30 August 2024

Source: BBC

Why Nigeria goment dey delay to implement di Oronsaye panel report

President Bola Tinubu President Bola Tinubu

Analyst don tok say goment of Nigeria dey delay to implement di Stephen Oronsaye Panel report sake of say dem dey try manage di situation.

Di panel report dey recommend merging, scraping and relocation of some parastatals and agencies to cut cost of governance.

Despite announcement for February 2024 say Nigeria President Bola Tinubu don approve di full implementation of di report, notin don come up.

For Tuesday 27 August 2024, di Chief of Staff to di president, Femi Gbajabiamila say to implement di Orosanye report go come out but e no fit tok wen.

Wen e dey follow journalists tok, Gbajabiamila say di goment dey take dia time to implement di report and dem don setup committee.

"We dey work on di Orosanye report, e no dey easy. Committee don dey setup and di report go come out."

Di big question na why goment dey delay to implement di Orosanye report?

Analyst tok why goment dey delay to implement di report

Ogbonge analyst Ayobami Steven say e get different reasons wey go dey make goment dey delay to implement di Orosanye report.

E say as di report dey recommend di scrapping or merger of some goment agencies and fit "lead to lost of jobs" and fit no go well wit dose wey dey affected.

"Di Nigerian goment no fit afford lose pipo wey be goment officials make dem no get job.

"Di goment dey dey veri careful to manage di situation as di lost of job by pipo go affect some states too," e tok.

Steven add say, di implementation of di report fit make some goment policies weak.

Wetin dis analyst also tok wey dey make goment delay di implementation of di Oronsaye report na di slow time wey e dey take for goment agencies to do tins.

"To implement some process dey always slow sake of official delays, rules and inefficiencies, " Steven tok.

Meanwhile, Chief of Staff Gbajabiamila say e no fit tok wen di implementation go happun but e go soon come out.

"Evribodi dey wait for di implementation of di report, I no fit tok di timeline but we no fit use anxiety do am. E go come out soon," Gbajabiamila tok.

As at di time wey dem submit di Oronsaye report, na 541 goment parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey for di kontri, but now e don increase.

At present, di number of federal agencies, commissions and parastatals don increase and e dey estimated to dey close to 1000, according to one report by The Cable.

Key tins to sabi about di Stephen Oronsaye Panel report

For 2011, former Nigeria President, Goodluck Jonathan, bin set up di Presidential Committee on Restructuring and Rationalisation of Federal Goment Parastatals, Commissions and Agencies, under di leadership of former Head of Civil Service, Stephen Oronsaye.

Di Presidential Committee get di following members - Stephen Oronsaye, Chairman; Japh CT Nwosu, Member; Rabiu D. Abubakar, Member; N. Salman Mann, Member; Hamza A. Tahir, Member; Adetunji Adesunkanmi, Member and Umar A. Mohammed, Member.

For April 2012, di committee submit one 800-page report, wey establish say na 541 federal goment parastatals, commissions and agencies (statutory and non-statutory) dey.

Di report reveal high level of competition among dis several agencies wey dey perform similar roles, and dis no only dey create unhealthy rivalry among dem but e also bring about unnecessary wastage in goment expenditure.

Di panel bin recommend say make goment reduce 263 of di statutory agencies go 161, scrap 38 agencies, and merge 14 agencies to departments for ministries.

Di panel also recommend di discontinuation of goment funding for professional bodies and councils. Dem say dis measures go free funds for di much-needed capital projects across di kontri.

Former President Goodluck Jonathan no implement di report but for March 2014, e set up one White Paper Drafting Committee wey di den Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Mohammed Adoke head to study di recommendations and produce a White Paper on di report.

President Bola Tinubu wen e assume office for 2023, bin notify professional bodies and councils say dem go stop to dey fund dem beginning from di 2024 budget in line wit di decisions of di Presidential Committee on Salaries (PCS).

“I wish to inform you say di presidential committee on salaries (PCS) for dia13th meeting don approve di discontinuation of budgetary allocation to professional Bodies/Councils effective 1st January, 2024. You go dey required, effective 1st January 2024, to dey fully responsible for your personnel, overhead and capital expenditures," e tok.

Meanwhile, wen di immediate past president Muhammadu Buhari step into power for 2015, e promise say im go implement di recommendations on di Oronsaye report.

Di Buhari Administration bin establish di Bukar Aji Committee to review di White Paper wey Goodluck Jonathan administration bin prepare bifor.