BBC Pidgin of Thursday, 17 November 2022

Source: BBC

Why South Africa pipo dey surrender dia pet pit bull dogs

Pit bull photo Pit bull photo

Pipo for Bloemfontein, Free state, South Africa don surrender almost 50 of dia pit bull dog pets.

South Africa Society for di Prevention of Cruelty Of Animals (SPCA), say di pet owners dey surrender dia pit bulls afta di attack of one 8-year-old pikin for weekend.

According to tori pipo Times Live, on Sunday, Free state police announce say dem shoot one pit bull afta e tear di 8-year-old boy to death for im house for Vista Park, Bloemfontein.

Tori be say di dog bin escape from di area wia dem keep am, jump over fence, enter di neighbour compound around 2pm dat Sunday.

Police say di dog attack di pikin wey bin dey play alone, bite am seriously for neck and chest.

Di pikin die on di spot.

So many complain already bin dey ground on deadly attacks of pit bull dogs and pipo don dey call make dem ban am as domestic pet.

already nearly 90,000 pipo don sign online petition in support of di ban.

Sizwe Kupelo Foundation, wey dey behind di petition, say di push for di ban na "sake of di attacks wey be like e just dey continue nonstop".

South Africa get one of di highest incidents of deaths wey relate to dog attacks for world relative wen you compare di number to im population, according to reports.