BBC Pidgin of Friday, 18 November 2022
Source: BBC
Nigerian superstar singer, Ayodeji Balogun wey dey popularly known as Wizkid don touch di heart of plenti fans afta e pay tribute to Davido late son, Ifeanyi Adeleke Jnr.
Wizkid give Davido shoutout for im soldout concert wey dem recently do for Madison Square Garden, New York on Wednesday.
During di concert, Wizkid official Disc Jockey play Davido debut hit song, “Dami Duro”, for di venue.
For di video wey don go viral for social media, one voice wey like Wizkid own say; “Davido we love you, OBO we love you”… Dis one na for Davido" as di singer music dey play loudly for di concert.
Nigerians react
Di video of di concert wey dey trend also show moment wen di venue go into brief darkness to further mourn di tragic death of di 3 year old.
Di excited audience wey join too begin sing Davido "Dami Duro" song as e dey play.
Nigerians for social media don begin react and shower praises give Wizkid for im support and love for Davido.
Wizkid showing love to Davido at Madison square garden was the highlight of last night. #WizKid???? #Davido #WizkidxMSG pic.twitter.com/V5WMs30jhz
— The Cutting Floor (@cuttingfloorng) November 17, 2022
Wizkid paying a tribute to Davido’s son at his MSG show is the sweetest thing I’m hearing today.
— B.O.D Republic (@bod_republlic) November 17, 2022
Wizkid showing davido love is consoling...it’s emotional. I pray from my heart for davido n Chioma to find peace of mind anywhere they are. May the beautiful soul of this young innocent child continue to rest on...deim????????
— melendez (@akblixx) November 17, 2022
Moment @Wizkid paid tribute to @Davido at his concert. There's room for love to go around.
— Melanin News HQ (@melaninnewsHQ) November 17, 2022
Video credit @TheMofeoluwa#MLNnews #WizkidxMSG#Wizkid #Davido pic.twitter.com/bXKsz13A3E