Nigerian superstar musician Ayra Starr don becom di first woman wey go carry di award for best African music for di Mobo Awards in di last 16 years.
Di singer also gbab di award for best music act, as di first woman ever to do am, for di ceremony wey happen for Newcastle.
As she collect di award, Ayra Starr acknowledge di fact say na her first Mobo win.
She tok say, "Dis dey nice. Dis na my first Mobo and na di first time wey I dey win Mobo awards. I dey shake now sef, I dey nervous.
"Thank you to every one wey support me. Thank you to my team, my amazing Mobstars, my amazing brother wey I dey follow make music wit, di producers for studio, my studio partners in crime, my label, Mavin records. Shout out to my mummy!!!"
Apart from Ayra Starr, rapper Central Cee also make history for Mobo as di first artist wey dem go name as best male act three times.
E don also match Stormzy record as di most decorated rapper for di award history.
MOBO or as dem dey call am, Music of Black Origin, na joinbodi wey dey celebrate black pipo music.
Di founder of di joinbodi na Kanya King wey borrow money on top her house to start am.
Na Ghanaian papa and Irish mama born Madam King wey bin start to make money for her family at di age of 17.
Di British award show bin start for 1996 and don host plenti artists wey include Beyonce, Rihanna, Sade, Lionel Richie among odas.
Di Awards claim say dem don help di career of artistes like Stormzy, Craig David and Rita Ora.
Dis year na di first award show since, Kenya King find out say she get stage four bowel cancer.
She bin come stage to collect surprise award and tok for her speech say she bin dey very grateful "becos time bin dey wen I tink day I no go make am".
She add say, "next year dey mark our 30th anniversary, and I wan make sure say I dey dia."
MOBO 2025 winners full list
Best male act - Central Cee
Best female act - Darkoo
Best newcomer - Odeal
Album of the year - Bashy, Being Poor Is Expensive
Song of the year - Darkoo feat. Dess Dior, Favourite Girl
Video of the year - Mnelia, My Man
Best hip-hop act - Bashy
Best grime act - Scorcher
Best drill act - Pozer
Best R&B/Soul act - Odeal
Best media personality - 90s baby show
Best African music act - Ayra Starr
Best performance in a TV show/ film - Jacob Anderson as Louis in Interview With The Vampire
Best electronic/ dance music act - TSHA
Best gospel act - Annatoria
Best jazz act - Ezra Collective
Best producer - Juls
Best Caribbean music act - Shenseea
Best alternative music act - ALT BLK ERA
Best international act - Ayra Starr
MOBO paving the way award - Denise Lewis MBE
MOBO impact award - Vybz Kartel
Kenya King wey dey diagnosed wit bowel cancer still attend di awards