Di ogbonge health bodi World Health Organisation(WHO) don tok say suspension of funding through di United States Agency for International Development (USAID) fit cause immediate stop to HIV treatment, Tuberculosis and oda disease outbreaks.
WHO don alreadi tok say eight kontris don get disruptions to drugs and dem dey run out of medicine for HIV treatment.
Dis kontris include Nigeria, Kenya, Mali, Haiti, Lesotho, South Sudan, Burkina Faso and Ukraine dey at risk.
Dis na according to Tedros Adhanom Ghebreyesus, wey be di Director-General of di ogbonge health bodi, during im briefing on Monday 17 March, 2025.
Meanwhile, dis concern dey come afta US President Donald Trump cut aids to different kontris through di USAID wey e say e no represent value for money for American taxpayers.
WHO tok say even if di US go cut direct funding to kontris, make dem do am in an orderly manner.
On di oda hand, di ogbonge health bodi lament say di funding cut fit spoil all di 20 years work wey dem do for HIV programmes and oda health emergency response.
"Di suspension of most funding to di president emergency plan for aid relief cause immediate stop to services for HIV treatment, testing and prevention for more dan 50 kontris."
"Eight kontris don get disruptions to antiretroviral therapy and go run out of medicine in di coming months," WHO tok.
WHO dey fear say if di funding cut really stand, e go increase di number of deaths wey dey related to HIV. Di bodi tok say e fit lead to about 3 million deaths.
Dr Tedros say, "Disruption to HIV programmes fit undo 20 years of progress, leading to more dan 10 million additional cases of HIV and 3 million HIV related deaths."
Di bodi recognise say US fit pull out but make dem do am in a way wey go ensure say affected kontris go fit find alternative sources of funding.
USAID alone dey employ around 10,000 pipo wia two-thirds of dem dey work abroad but di cut go surely affect dis number and health workers go dey stranded.
Many sabi pipo don raise concern say di move to end USAID fit get serious impact on humanitarian programmes around di world.
Even though, some of di main reasons why dem set up di USAID for early 1960s na to release humanitarian aid programmes on behalf of di US goment around di world, Trump say e no dey help Americans and e wan end am.
Kontris wey dey run out of HIV medicines
WHO tok say eight kontris out of dia 194 member state dey at risk of running out of medicines in di coming months as di USAID funding cut don dey affect dem.
Dis na kontris wey dey risk of oda outbreak infections and emergencies, according to WHO:
.Nigeria
.Haiti,
.Kenya,
.Lesotho,
.South
.Sudan
.Burkina Faso,
.Mali
.Ukraine
Di bodi say dem dey work wit team to see how dis funding cut no go affect dis kontris for future.
As part of solutions to help di kontris wey go soon run out of medicines and oda health related vaccines, WHO say dem go try find more money from oda donors.
"We go try cut some spending and find more money. If we get less money, we go deliver less and we gatz prioritise our spending. To get US on our side go good but if not, we gatz move on as dem get choices to make."
Wetin e mean for Nigeria
Meanwhile, according to di US foreign assistance website, USAID intervention for di Nigeria health sector include to combat diseases like HIV/AIDS, Tuberculosis, Malaria, and also for maternity and child health.
For 2024 alone, di intervention on HIV/AIDS dey more dan $140 million. But once di USAID direct funding stop, e go affect di Nigeria healthcare system and HIV patients go dey at more risk.
BBC Pidgin tok to some sabi pipo on how dis funding cut go affect Nigerians especially now wey di kontri dey run low of HIV medicine, according to WHO.
One oga for di USAID partner organisation tell BBC Pidgin say HIV medicines dey expensive and if US no support again, patients for Nigeria no go fit cope.
"HIV/AIDS medications dey veri expensive and if e no be for di help from US, I no tink say Nigeria go fit cope wit di cost of combating di disease effectively for di kontri,"
"If dis funding dey cut off, e mean say dis patients no go fit access dis life-saving medications wey dey help dem to live dia normal life."
Also, di National Agency for di Control of AIDS (NACA) release a statement bifor through dia Director-General Temitope Ilori, wey tok say intervention by US dey cover approximately 90% of di total HIV/AIDS treatment burden for Nigeria through di Presidential Emergency Plan for Aids Relief (PEPFAR), a project wey dey funded by USAID.
But now, dem go need to dey mindful of di changes wey happun as dem dey look to achieve di target of ending AIDS by 2030.
She add say Nigeria go dey affected but govment go need to "intensify domestic resource mobilisation strategy towards ownership and sustainability of di HIV response for di kontri".