Russia and Ukraine don launch air attacks wey destroy each oda infrastructure overnight, hours afta Russia President Vladmir Putin reject US President Donald Trump proposal for one full 30-day ceasefire.
For one phone call on Tuesday, 18 March, Putin bin tell Trump say full ceasefire go only work if Ukraine allies stop to dey give Ukraine military assistance, and e agree to stop to only stop attacks on Ukrainian energy sites.
Ukrainian President Volodymyr Zelensky tok say last night attack damage civilian infrastructure wey include one hospital for Sumy.
Meanwhile, di Russian defence ministry tok say out of di 57 Ukrainian drones dem intercept and destroy overnight, 35 bin dey ova di Kursk border region.
For Belgorod, one Russian region on di border wit Ukraine, di govnor tok say di situation "still dey difficult". Moscow bin tok on Tuesday say Ukrainian forces bin attempt one ground assault on Belgorod but dem push dem back.
Officials for di southern Russian region of Krasnodar tok say one Ukrainian drone attack bin spark small fire for one oil depot.
Meanwhile, di two kontris don agree to swap 175 prisoners each today.
Wetin dem agree and wetin dem no agree for di Trump-Putin call
US President Donald Trump and Russian President Vladimir Putin bin tok for almost two hours yesterday – here na brief overview of wetin dem tok say dem discuss.
Vladimir Putin reject one immediate and full ceasefire for Ukraine, e agree to only halt di attacks on energy infrastructure, afta one call wit US President Donald Trump.
Di Russian president no gree sign up to di comprehensive one month-long ceasefire wey Trump team recently work out wit Ukrainians for Saudi Arabia.
E say comprehensive ceasefire go only work if foreign military aid and intelligence sharing wit Ukraine stop. Ukraine European allies bin previously reject di conditions.
US toks on Ukraine go continue on Sunday for Jeddah, Saudi Arabia, di US envoy to di Middle East, Steve Witkoff, tok.
Wetin dem agree
Energy attack pause: Russia tok say dem accept one proposal say make both sides stop to dey target energy infrastructure for 30 days, and dem pass dat order to di military "immediately
More tok-tok: Mediators go continue to tok as part of efforts to resolve di conflict, as di US say negotiations go begin "immediately" for di Middle East
Black Sea negotiations: Both di US and Russia go carry out specific negotiations on one potential form of maritime ceasefire for di Black Sea
Russia and Ukraine to exchange prisoners: Russia and Ukraine go exchange 175 prisoners each today. Russia go also release 23 wounded Ukrainian servicemen from Russian medical facilities.
Wetin dem no agree
Full ceasefire: Russia no agree to a proposal, wey di US and Ukraine support, for one immediate 30-day ceasefire on land, air and sea
Conditions for peace: Putin tok say "di key condition" for achieving a lasting resolution go be for Ukraine to stop rearm and receive military aid and intelligence support - di US read out no mention am.
Based on di information wey US and Russia provide, e neva clear how Ukrainian involvement go be in future negotiations or if any agreement dey on dat issue.
Trump and Putin agree to immediate technical-level talks towards a longer-term settlement, wey di Kremlin say must dey "complex, stable and long-term in nature".
But e neva clear if e mean further negotiations between di US and Russia, or bilateral talks between Russia and Ukraine.
Di Kremlin also say Trump support Putin idea of holding ice hockey matches between professional US and Russian players.
Dem bin remove Russia from ice hockey events overseas afta di kontri Ukraine for 2022.
Kyiv go probably see di outcome of Tuesday much-anticipated phone call as Putin playing for time, while e add crippling conditions on any settlement.
Putin don previously insist say Russia go keep di control of Ukrainian territory e seize and e say make dem ease di Western sanctions on di kontri as part of any eventual peace settlement.
Earlier dis month US bin temporarily suspend military and intelligence aid to Ukraine afta Trump and Zelensky get one kwanta for di Oval Office.
For one news conference on Tuesday for Berlin wit French President Emmanuel Macron, German Chancellor Olaf Scholz say di limited ceasefire plan na important first step, but e again call for a complete ceasefire.
Meanwhile, UK Prime Minister Sir Keir Starmer wey follow Zelensky tok afta di Trump-Putin call "reiterate UK unwavering support", one Downing Street tok-tok pesin tok.
US President Donald Trump and Russian President Vladimir Putin bin tok for almost two hours yesterday