You are here: HomeAfricaBBC2024 05 10Article 1930201

BBC Pidgin of Friday, 10 May 2024

Source: BBC

Accident involving ex-Super Eagles player Tijani Babangida – wetin we know

Former Super Eagles forward, Tijani Babangida Former Super Eagles forward, Tijani Babangida

Former Super Eagles forward, Tijani Babangida survive deadly accident wey claim one life.

Di incident happun on Thursday wen Babangida dey on one trip along di Kaduna-Zaria road for Northern Nigeria.

Tori be say di former Super Eagles player dey inside di motor wit im wife and younger brother, Ibrahim Babangida.

While Tijani and im wife escape wit injuries, im younger brother die for di accident.

“Na true.” Ex international Garba Lawal confam di tori to BBC.

Lawal say “Babangida alongside members of im family get accident today. Unfortunately we lost Ibrahim but Tijani and im wife dey for hospital.”

Anoda former teammate, Emmanuel Babayaro say make Nigerians pray for Tijani Babangida an im family.

“Comrades! Make we come togeda in prayer for our president, Tijani Babangida, wey involve for motor accident along di Kaduna-Zaria Road,” Babayaro announce.

Tijjani Babangida na member of di Dream Team wey win di Gold for di 1996 Olympics.

Nigerians remember Babangida for di two gaols wey e score against South Africa wey make Super Eagles for di 2000 Afcon final wey Ghana and Nigeria co-host.

Tijani Babangida dey currently serve as di President of di Professional Footballers Association of Nigeria (PFAN).

Dem born am on 25 September, 1973 for Kaduna state, north west, Nigeria.

During im active years, e play for Dutch club Ajax, VVV- Venlo, Roda JC and Vitesse, Al-Ittihad and Chanchug Yatai.

For im international career e play for Super Eagles between 1994 to 2004. E get 36 caps and score 5 goals.

As a professional player, im bin win di Eredivisie and KNVB Cup.

For Nigeria league e play for Niger Tornadoes between 1990 and 1991.

Im be former Nigeria International and bin play as a winger for di Super Eagles.

For di 1998 World Cup for France, im play 4 matches and score one goal.

Tijani Babangida na part of di 1996 Olympic team wey win gold for Atlanta 96’.

Nigerians remember Babangida for di two goals wey e score against South Africa wey make Super Eagles for di 2000 Afcon final wey Ghana and Nigeria co-host.


>