BBC Pidgin of Tuesday, 30 May 2023
Source: BBC
Roma boss Jose Mourinho say "history no dey win matches" but sometin go give in for Wednesday Europa League final against Sevilla.
Sevilla, neva lose Europa League final before, dem don win di competition six times while Mourinho don win all five European final wey im don dey involved in.
Dia 62-year-old coach neva win a major trophy - while Mourinho, 60, don win di Champions League wit Porto and Inter Milan, league titles and cups for Portugal, England, Italy and Spain, di Uefa Cup/Europa League wit Porto and Manchester United, and last season Europa Conference League wit Roma.
Sevilla, bin win di 2006, 2007, 2014, 2015, 2016 and 2020 finals, but dem bin face relegation trouble until dem appoint Jose Luis Mendilibar for March.
Neither of di team fit finish for di top four of dia league, while Sevilla dey - 11th for La Liga – dem fit miss out on Europe entirely.
Di winners of di final for Budapest Puskas Arena go play for next season Champions League -for di two teams dat na dia only hope to do so.
So who go win, play and what time be di match for di Europa League final?
All di answer dey inside dis tori.
Sevilla vs Roma Prediction
Sevilla form going into dis final beta pass Roma own. Na wetin football expert Bolarinwa Olajide tok.
Roma look like team wey dem don switch off for di Italian league so dat dem fit concentrate to win di Europa League. Olajide add.
Dis two teams get different style, Sevilla get more attacking options available to dem, and dem bi specialists for dis competition.
But Jose Mourinho men sabi defend and if dem score goal, dem know how to manage di game.
For me based on Roma style of play and manager, I feel say dem go secure dia second consecutive European trophy.
Prediction: Sevilla 0-1 Roma
Sevilla vs Roma kick off time
Di game go take place for Puskás Aréna, Budapest.
Kick off for di match na 8:00pm West African time on Wednesday May 31.
Fans fit watch di game live for Nigeria and Ghana for one of di Supersport channel for DSTV.