You are here: HomeAfricaBBC2023 07 24Article 1811096

BBC Pidgin of Monday, 24 July 2023

Source: BBC

Tanker explosion kill pipo wey dey scoop fuel for Ore

Di tanker explosion Di tanker explosion

About 10 pipo don die as dem dey try scoop fuel from tanker wey fall for Ore, Odigbo Local Goment Area of Ondo State on Sunday 23 July.

Di tok-tok pesin for di Police Command for Ondo State, SP Funmilayo Odunlami-Omisanya tell BBC Pidgin say dem receive news of di incident and as at 23 July na eight pipo dem fit confam say die.

SP Odunlami-Omisanya say di tanker catch fire wen pipo bin dey scoop fuel.

“Di tanker fall and pipo bin rush dia to park fuel, and as dem dey park am, di tanker explode. As at yesternight na eight pipo die,” Odunlami-Omisanya tell BBC Pidgin.

However, local tori pipo The Nation say eyewitness claim say na 20 pipo die for di incident including three pikin dem and one pregnant woman.

No be di first time wey pipo wey go scoop fuel afta tanker fall go dey caught up in di middle of an explosion.

One of dis incident happun for January 2019 for Odukpani, Crosss River State, south-south Nigeria, and na at least 12 pipo die wen one oil tanker explode wen pipo dey scoop fuel.

Police for di state say dem recover deadi bodi of pipo wey die for di explosion and take odas wey sustain serious burns to di hospital.

Anoda incident happun for July of di same year for Benue State wia at least 45 pipo lose dia lives afta petrol tanker explode.

Di driver of di tanker bin lose control of di vehicle afta trying to dodge one pothole, eyewitnesses tok.

Tori be say di tanker catch fire afta one exhaust pipe from one bus wey dey pass scrape di ground and cause sparks to fly.

Eyewitnesses say pipo bin gada around di crashed tanker afta di crash as some of dem attempt to scoop fuel.

Refresh your browser for more updates as dis na developing tori