You are here: HomeAfricaBBC2024 02 26Article 1918801

BBC Pidgin of Monday, 26 February 2024

Source: BBC

Tori of coup plot for Nigeria na lie - Defence Headquarters

Some Nigerian soldiers Some Nigerian soldiers

Nigeria Defence Headquarters don hala say tori wey dey spread round say high alert don dey sake of coup plot for Nigeria na lie.

Di fake tori bin add say di suspicion na im make dem call emergency meeting wey President Bola Tinubu bin dey inside.

Oda pipo wey dem allege say bin dey di meeting na di chief of staff to di President and di Commander of di Guards Brigade.

For statement wey dem release on Monday, dem reveal say di tori wey comot on Sunday say, "di Guards Brigade don dey put on high alert on top unusual movement wey cause suspicion of coup plot for Nigeria", Brigadier General Tukur Gusau, acting Director Defence Information tok for statement e sign on Monday.

Defence Headquarters add say dem "wish to categorically state say di allegation dey false."

Dem explain say di Guard Brigade work na to protect di seat of power wey be di Presidency.

Becos of dat work, dem dey also protect di Federal Capital Territory so dem always dey on high alert.

Defence Headquarters also don comot to say dem go go court on top di pipo wey face di fake tori.

Dem say na because do pipo bin do am to create unnecessary tension for di kontri.

Already, Chief of Defence, General Christopher Musa don come out on different times to clear pipo on how members of di armed forces tanda gidigba on top di protection of Nigeria.

For West Africa, na three different kontris currently dey under military occupation, Burkina Faso, Mali and Niger.

Nigeria currently dey for middle of high cost of leaving as floating di naira currency, don lead to major drop in the value of di currency against di dollar.

Recently, thousands of Nigerians enta streets for di northern states of Niger, Kano and Kogi and Oyo for western Nigeria, to demand urgent interventions wey go address di rising cost of living as dem claim say di situation don become unbearable.

Price of food items dey increase for dia fastest rate in nearly 30 years.

Official record from di Nigeria National Bureau of Statistics (NBS) report say inflation dey at 29.9%, di highest in almost three decades, and food inflation tanda for 35.4%.

On top of dat, di power industry for Nigeria wey don be major wahala for di kontri be like e don turn worse.

In fact, di national grid don collapse at least four times between September 2023 and February 2024.

So already tension don dey build for di kontri.

Wetin be di work of di Guards Brigade

Di Nigerian Presidential Guard Brigade na unit of di Nigeria army wey dia main work na to protect di seat of power, wey for Nigeria be di Presidency.

Dis also mean say apart from di person of di president, di work of protecting di presidency also extend to anyone wey fit take ova presidential duty, like Vice President, Senate President and Speaker of House of Representatives.

E also include pipo wey dey close to di president like di First Lady of Nigeria.

Dem dey also work with Nigerian Police to secure areas for di Federal Capital Territory.

Di Nigerian Guard Brigade also get di work of mounting di guard of honour on behalf of armed forces for important national events like di Armed Forces and Independence Day.

Timeline of West African coups wey don happun

For May 2021, Col Assimi Goïta seize power from di transitional goment say dem wan scata di kontri transition to democracy.

Na di same bin organize di 18 August 2020 coup wey pursue di elected head of state, Ibrahim Boubacar Keïta.

For September 2021, one surprise military coup for Guinea end di controversial tenure of President Alpha Condé, less dan one year afta e win third term wey follow deadly protests and serious restriction on di opposition.

Members of di elite Special Forces (GFS) bin detain 83 year old Condé on September 5, hours afta dem report gunfire near di presidential residence for Conakry.

GFS Commander Colonel Mahamady Doumbouya confam di takeover on top di state TV and promise to conduct peaceful transition.

Burkina Faso bin go through two coup wey work within nine months of each oda.

For 30 September 2022 Captain Ibrahim Traoré overthrow Lt Col Paul-Henri Damiba afta e accuse am say e fail to fulfil im promise to stop di Islamist insurgency wey don hold down Burkina Faso since 2015.

Damiba bin take ova power for January of dat year.

For July 2023, sojas go to detain di Niger President Mohamed Bazoum for military coup.

Dis na wen General Abdourahmane Tchiani don declare imself di new leader of Niger afta di coup.

For 26 August 2023, Gabon oin di ist of kontris to abandon democracy wen Gen Brice Oligui Nguema comot President Ali Bongo from power lock am inaisw house arrest.

Na later in September dat same ear wey dem announce say dem don release am for health reasons.